you can Subscribe using RSS

Submit your Email

Friday, February 26, 2016

Power of sleep

Unknown

... This exam no be joke o..

No be small Wahala for boys hostel o.
My guy don Jack Jack Jack....  As e enter room lock door sleep.  To wake My guy na war o

No kind knock dem no do for there o
Even the banging no be here. , My guy no even shake body oo. 

Guys don dear fear say Em don die ooo

Na until dey turn go back of room dey bang. After much much b4 my guy wake ooo

Make Una take am easy oooo.. 😯

Thursday, February 25, 2016

FuW una money don finish??

Unknown
I still remember when money still plenty. Una no dey allow persson see money,   now na atm dey beg una to come withdraw... atm dey free anyhow like say money no dey the machine

exam day 4.

Unknown
My people how una dey? How exams levels?

First week don dey finish o,

4 days of exam don waka.

Una no vex as plenty talk no Dey
Na exam cauz  am o.

Still wishing una success

Tuesday, February 23, 2016

important tip

Unknown
Abeg we don dey hear complain say dem thief bag dem thief money e.t.c

Pls mmake una keep una valuables for house b4 una come exam.

Na only u suppose waka com o

EXAMS HAS BEGUN

Unknown
On behalf of the fuwukarigist family, we wish all students of FEDERAL UNI WUKARI. Success in exams as it begun this week.

Friday, February 19, 2016

tgif turnup!!

Unknown
Friday gbudu. Don show

Abeg how una dey rock am this weekend?

Mr n Mrs kwararaffa ddey shele for Lencon this night...
Sha turn up dey ever day. TDB sef na turnup o!

FUW miss Rotaract fainty fainty

Unknown
Hmmmmmm.
My people, I hear say, I even follow see o.

Our latest Miss Rotaract jam hot sun + exam card waka...

Na so aunty rotaract just off engine.


We wish am better recovery o

Abeg make una try dey fear this sun o...even my eye just dey up up up.

Thursday, February 18, 2016

FUWUKARIGIST instagram challenge

Unknown

Hello dear fans.
In a bit to say thankyou for joining the fuwukarigist family,

We present the instagram challenge.

.to participate :
1. Snap a picture showing ur exam spirit and preparation
2. Upload it to instagram with the hashtag #fuwukarigist
#examInFuw and tag @fuwukarigist to qualify.
3. Picture with highest likes wins free Airtime .

Winner is announced sunday 21st febuary. Entry closes 8pm winner Announced 10pm

Prof Aremu starts acting

Unknown

So like play like play. Our general don move o.
We go miss our prof Okogba..anytime u miss former vc, just stroll go prof okogba drive

.and acting vc don start waka. We see prof dey cruise official SUV with security 💂....

SUN........black men rising

Unknown
Chai.. sun for wukky town today no b here o, abeg how we go survive na. Shey na like this we go dey dey? Black men dey turn shadow men, fair men dey turn black Men

Tuesday, February 16, 2016

98days for the thief 2days for Fuw Guys

Unknown

Kai..  Sha boys ain't smiling o

The same nigga raw wey boys catch last week for school unto moving phones levels.....

Same nigga show face for hostel today o..  Come see Wahala na

Guys dey vex o.. Thank God for Porter wey no allow make guys carry that nigga.. The eyes I see Fit kill that guy o.. Sha student affairs come carry am go... 

Woju o..  Guys no smile sha.... 

Monday, February 15, 2016

Fire In female hostel

Unknown
Guys wahala dey o..

All our girls just dress hot hot yesterday , too much heat for one place na em cause Fire for girls hostel .....

Porters Sha no dey smile o... Kai 
Na yesterday I Sabi say na only you waka come o
, see huzzle oo.

 Sha shoutout to FU guys una no fall Hans 

Na yesterday I see security wey no fit operate fire extinguisher 
....

Advantage advantage advantage .. After the fire call ur boo ......lol

Na cuddle upon cuddle o

No girl sleep inside block A o. Abeg where dem sleep???

Valentine to remember. ... After the show

Unknown
Valentine has come and gone ..

Hope una Don jolly safe .

Hope ur boo na ur boo

And sum people don realize say dem no be the boo of their boo

..".........another val go come o,
Make una start to find boo for una sef 

Saturday, February 13, 2016

☆Happy☆ ♡Valentine's♡ ☆Day☆

Unknown

☆Happy☆ ♡Valentine's♡ ☆Day☆

My humble self #Mr.Connect

Humbly wishes the entire Fuw family a big Happy Valentine's Day....

Show some love today,  use ur head oo

Valentine is just one day,  but showing love is a continuity..  

Turn up safe and right..  

Mr.Connect says so

......invite it friends to join the family... 

Pre valentine fail

Unknown

I hear say dem host pre valentine show and na only organizer dey present..  Fuwukari there is God o..

But imagine say na only you com go there 😂😂😂😂😂😂😂😂😂

HDS Dinner /award Night..... As e shele

Unknown

My fellow people..  When water pass Garri Wetin man go do?

Bcoz Fot this matter Ehn
Water pass garri ooooo

Our people for history diplomatic do their thing this night oo..  The turn up massive,  the chop breke,  even the DJ just dey gimme inspiiiraa. 

But as water pass garri  , na condition make crayfish bend o.  And for the award na condition make Bobby comot for cloth o

No Be me talk am o..  Na Wetin we carry eye see o. Na so contestant dey shake body, na so Bobby press escape for inside cloth,  and as the gbedu dey hot,  them say na mama dey call her pikin enter house , but this mama dey feel gbedu  till she nor know say pikin don comot for house oo...

We sha thank baba God say everything don come Don go...  Till next year be that o...

Sha that most endowed award recipient na something oo. We can't that one v12 engine😁😁😁

Leaders house.... Day 2

Unknown

Sha sha sha..  Day one was activation  .. Day 2 just go silili weele... 

Sunday na the hottest valentine Fiesta.. 

Venue :plaza opp federal university  ....

8a.m both dulling

Idoma Day Burn fire

Unknown

still on the mater yesterday na serious turnup , rag day for morning then burn fire for night...
If u no show face u miss o... All work no play makes Kelechi a dull boy o ...

From the crowd to the dance to the palm wine to the yam n oil o the cultural wrestling every single activity was a hit back to back ..

See pictures from the idoma burn fire

FUWUKARI calendar ...com n see

Unknown
monday Tuesday Wednesday Thursday Friday Monday Sunday .



Abeg I hope say no be only me dey see this thing ...Saturday no dey FUW Ooo

See as Saturday Don busy pass normal Monday sef ... As I enter school today I come shock o

Na only uniform remain Oo .. Dem won kill us ??

Test on test even people dey queue to write test now ... No be beans oo

FUWUKARI gets a new V.c

Unknown
Every single bread was a hit .
From crisis bread to I go Abuja bread to I go U.S bread


Sha change is constant ... Change Don show reach our way o.

GCFR don Sama FUW and dem other new Uni' s with change of leadership


And the new man wey dey Carry FU for me head like jerry coil na


PROF Muhammed Kundiri.




How una see the matter na ..????

Leaders house 3day power weekend

Unknown
Well ....there is God in everything we do.


Leaders house Don start one better program tagged AN EXCELLENT SPIRIT

day 1 was activation service


Go follow collect yA share of the annoiting and blessing plus spirit wey excellence oo

Venue : plaza ..opposite federal university


....blessing follow u

Friday, February 12, 2016

RAG DAY OF HDS

Unknown
NA SO KRAZE DEY START ....


Sha Sha sha ... Still on the matter I sure say una follow me see the small dope KRAZE wey happen today .......

Men history students killed it in their various rags n raggagis .. But na one guy wey wear wig catch me o ...



Nice one from them Sha ... But I hope say no body graduate from there to next level craze lol ....



Pics coming soon .. Send ur pictures from the rag day to portalconnect020@gmail.com



To have them featured

Wednesday, February 10, 2016

You got gist for us

Unknown

Dear readers..  Call me MR. Connect

If you got pics videos exclusive news you want featured on this site.

Send us your connect to portalconnect020@gmail.com

Thanks

test PALAVA

Unknown

I dey my own JeJe....  I hear say two test dey today,  same time, same lecturer.. Oya see Bois enter TDB and others STDB  ..

Still on the matter we enter hall,  after the whole palava,na so lecturer back us better yarn say na only one person do correct thing wey question ask o...

See Gobe.. Since then my face just reshuffle,  bois are not smiling oo......

Exams don show join

UNROMANTIC VALENTINE

Unknown

Love love love na  Em dey hot now..... 

EVEN UR BOO HAS A BOO.

UNROMANTIC VALENTINE.... 

Even me sef dey anticipate this one o...  The tag dey gimme Joy oo. 

Venue :Lencon Event Center 
Date : Sunday 14th February 

Dress code...  Rock from 80's 90's till date...  Let's see ur swag o..  Sha psycha no far ooo

Featuring :
Dance 
Comedy 
Love Q&A 
Gifts now loads more... 


Red carpet starts 6:00pm
Main event 7pm

Packaged by #thoseWhoKnowWhatsUp

VALENTINE TO REMEMBER

Unknown




Sha make Una hear ooo...

It's gonna Be a valentine to remember  , sources gate Inc with Dust To Don...  Don samba Wukky city with correct waka for Sunday val movement  ..

Shout out to boys wey won go 1st 2nd 3rd 4th and 5th service that day...

No fear  .. Correct waka don dey o..  And the beta thing na say entry na free  .😶 FREE FREE FREE😄

This awoof no dey purge o

Featuring : 
Mr pee
Das n Nino
JUC dancers 
Rock city crew. 
HRMajesty
Dahkeed

AND MANY MANY MORE LIVE ACTIVITIES TO KEEP UNA TOTORI..

VIP SINGLE : #500
COUPLE :1000
TABLE FOR 4 :1500
TABLE FOR 6 :2000

GET V. I. P TICKETS B4 14TH ABEG OOOO..

OTHERS NA ONLY U GO WAKA GO OOO

..NORMAL CLUBBING HOLDS AFTER THE EVENT BY 10

#500 FOR GUYS AND FRÉÉ FOR THR LADIES ..NO DULLING

HOST : MC PAUL

ON THE WHEELS DJ SARS...............   



TOUCH OF RED............

Coprights @ 2016, Blogger Templates Designed By Templateism | Distributed By Gooyaabi Templates