My fellow people.. When water pass Garri Wetin man go do?
Bcoz Fot this matter Ehn
Water pass garri ooooo
Our people for history diplomatic do their thing this night oo.. The turn up massive, the chop breke, even the DJ just dey gimme inspiiiraa.
But as water pass garri , na condition make crayfish bend o. And for the award na condition make Bobby comot for cloth o
No Be me talk am o.. Na Wetin we carry eye see o. Na so contestant dey shake body, na so Bobby press escape for inside cloth, and as the gbedu dey hot, them say na mama dey call her pikin enter house , but this mama dey feel gbedu till she nor know say pikin don comot for house oo...
We sha thank baba God say everything don come Don go... Till next year be that o...
Sha that most endowed award recipient na something oo. We can't that one v12 engine😁😁😁
0 comments:
Post a Comment