Thursday, July 21, 2016
END of SESSION
NOW THE DAY IS OVER ...............
SEMESTER TOO IS OVER ...
WISH ALL STUDENTS OF GREAT FEDERAL UNIVERSITY A BIG HAPPY HOLIDAYS ... TILL OCTOBER
..
FUWUKARIGIST WISH YALL HAPPY HOLIDAYS TOO. COS EVEN US DEY GO HOLS ...
THE START IS ALWAYS SMALLL, BUT THE NEXT STEPS ARE ALWAYS GREATER .....
PROMISING YOU A BIGGER BETTER MORE LOADED FUWUKARIGIST NEXT SESSION
ON BEHALF OF THE FUWUKARIGIST TEAM,
HAPPY HOLIDAYS!!!!! ALL THAT GOES SHALL RETURN SAFE O
#FUWGIST is an affiliate of PORTAL GROUP
our able team
*L0rDv3sT
*N3tesy Maximus
*Fr3shBoY
*mr Fuwukarigist
Tuesday, July 12, 2016
RIDDLE OF THE DAY????
SEE somethin,Hear Something
2:28 AM
answer this riddle oo
I NEVER WAS
AM ALWAYS TO BE
NO ONE EVER SAW ME NOR EVER WILL
BUT AM THE HOPE/CONFIDENCE FOR ALL THOSE WHO BREATHE AND LIVE
WHAT AM I??
Sunday, July 10, 2016
Good Morning FU
even as Portugal win France,
person cook for kitchen wey the aroma no allow boys sleep,
its another beautiful morning,
Good Morning Federal University
#save Next Generation
#TodayQueens
Respect your unborn children but if you are not ready, always remember to protect the future generation. Make ur pikin no come look u bad eyes.
#SaveGenerationN
RP: Ikyurior Madiba M. Orduen
exams graduallly wrappin
even tho some people just dey fully start,
others don finish o, more people joining the finish train o
to those wey don finish, Kudoz
to those still on board , Keep it Up
exam just slow school, even us for here sef don slow ,
but no lele , e go soon end
Tuesday, July 5, 2016
Barka de sallah
Unknown
12:58 AM
We at FUWukariGist celebrate our Muslim community a happy Sallah celebration...
Even tho they postpone am till tomorrow ,we go still turn up proper
Fasting no be beans o
If you get mind fast for 30days make we see how e go be
Body go tell you o
Abeg make una package meat for fuwukarigist ood

Monday, July 4, 2016
Birthday Wahala
Teedesigns
11:40 AM
Make una help me see wetin guyz d do 2 dem fellow nigga.....Say na Birthday
If na Bae nw.....dem no fit....do am like dat.....o....Anyway Happy Birthday 2 #Idoko
I pity d guy.. ......lol.
Saturday, July 2, 2016
Ahoha, hey
latest tori wey enter my ear, na say army men don dey
enter boi's life for ATM machine oooh.
as the tori been dey sha, them say boi's been full
the ATM yakata, and the line for ATM bend;bend like Malabo leg.
so d army people go comot koboko come flog people destiny comot from their body.
As una know say Pol sciences guys no dey carry last
na im one guy from their department dey complain say the guys for school no get mind.
but when dem army people turn back to see who get the mind,
the guy lock up sharp sharp like ashawo wey u no pay wan fuck.
but last last , e don tey wey i see ATM queue dey organized like today o
i almost think na election voting queue......

2 market days left for final year brethrens
yes o, so the new description we dey hear na MARKET DAYS oo
2 market days left for our very own Pioneer Final Year students
....chai chai chai
hmmm , i no even know wetin to talk ... enjoy them now o,
if u get crush for 400lvl wey never know by now, abeg sister , brother go open up o
if na beef , settle o .. cos na forward ever .....
PIc of the day
so i woke up to see this pictures going viral
this is no more reading Till day Brreak oo this is a serious case of Sleep Till Day Break
they can get expelled for this ryt????
this is no more reading Till day Brreak oo this is a serious case of Sleep Till Day Break
they can get expelled for this ryt????
Friday, July 1, 2016
EXam SCReeNING
hmm
the way screening be ehn, i even hear say , them dey screen your mind sef oo
you no even need to carry chokes b4 they nab you o, even just the thought of say u go ask person ,
dem don nab you o ......lol
even your own thoughts no safe witth you again o
EXAM MALPRACTICE STYLES
GREAT NIGERIAN STUDENTS!!
I SURE SAY WE FU STUDENTS NO GO RUNS AM LIKE THIS OO
#SHUNMALPRACTICE
happy new month
6 Months don waka, another 6 don start, we giva Baba God,Chineke,Allah thankz
on behalf of fuwukarigist we wish you the best of this month,,
plenty money follow you
Alubarika follow you
HAPPY NEW MONTH
Subscribe to:
Posts (Atom)